Model Nana Karagianni wey be one the sweetest journalist for Greece,don jam big wahala wey dem dey call ANOREXIA...country people,no be small tin o..even as she dey like dis, her husband still hold am well-well..the love carry weight...make una check out some of their pix...
I Welcome Una to Pidgin Xtra Blog.
For your current tori on Entertainment, Fashion, Lifestyle, Inspiration, Plus Even Gossip Sef... Everything Dey Here.
Wednesday, July 31, 2013
NO NAIJA FEMALE ARTIST FIT COMPETE WITH ME-TIWA SAVAGE
Tiwa wey be guest for this week edition of Rubbin minds, been yarn put after dem ask her sey, na who be the artist wey fear her fear among the female artist? she come yarn sey, no female artist fit shake her balance, sey the people wey she dey follow strugle with na the male artist, bcos she dey look ogbonga picture like, WIZKID, IYANYA,D-BANJ,ICE PRINCE,wey dey arrange different-different awards...
WONDER!!!!!
Dis baby wey u dey c so na big wonder. the baby dey weigh 6.10kg. Na for germany this thing happen. The pikin name na Jasleen (girl) and as e be so, the mama no born am tru operation o.wey oyibo go call caesarean section...the child comot tru normal delivery....Make una clap for Jehovah.
Saturday, July 6, 2013
TINSEL AUDITION!!
Hmmm! better tin don show for us oooooo. Tinsel wey be the award wining TV series don come With another new cast audition ooh. You wey sabi act, and wan follow dey for Tinsel,na ur opportunity be dis ooooh.below na the details For the auditioning;
Date-12th & 13th july 2013.
Venue-Protea leadway hotel.1,Mogambo close.Maryland estate,Lagos.
Time-8am
*Come with a recent studio 5 by 7 'clear' photograph of yourself..Note:picture should not be digitally altered or photoshoped.
I wish una d best****Wink**
Date-12th & 13th july 2013.
Venue-Protea leadway hotel.1,Mogambo close.Maryland estate,Lagos.
Time-8am
*Come with a recent studio 5 by 7 'clear' photograph of yourself..Note:picture should not be digitally altered or photoshoped.
I wish una d best****Wink**
Friday, June 28, 2013
Y THE OBAMAS NO SHOW NAIJA..
Naija na the most populous country and one of the richest in Africa, still US president Barack Obama no go still show Naija for this him Africa tour with his wife and daughters, instead dem dey go Senegal were dem dey presently), South Africa and Tazania.
USA check am sey na insecurity be one of the reasons president Obama no go show Naija.
Peter,Paul and Jude Okoye arrange =N=5million for OJB.
P-Square and their elder broda Jude(Engees) Okoye arrange =N=5million for our ogbonga music producer OJB wey need =N=16million to run kidney transplant... God go bless this guys well-well.
Wizkid with King Sunny Ade(KSA) wan tie nut.
Wizkid wey don run collabo with king of Afrobeat, Femi Kuti, wan tie anoda collabo nut with the king of juju music, King Sunny Ade.
Subscribe to:
Posts (Atom)