For your current tori on Entertainment, Fashion, Lifestyle, Inspiration, Plus Even Gossip Sef... Everything Dey Here.
Friday, June 28, 2013
Y THE OBAMAS NO SHOW NAIJA..
Naija na the most populous country and one of the richest in Africa, still US president Barack Obama no go still show Naija for this him Africa tour with his wife and daughters, instead dem dey go Senegal were dem dey presently), South Africa and Tazania.
USA check am sey na insecurity be one of the reasons president Obama no go show Naija.
Peter,Paul and Jude Okoye arrange =N=5million for OJB.
P-Square and their elder broda Jude(Engees) Okoye arrange =N=5million for our ogbonga music producer OJB wey need =N=16million to run kidney transplant... God go bless this guys well-well.
Wizkid with King Sunny Ade(KSA) wan tie nut.
Wizkid wey don run collabo with king of Afrobeat, Femi Kuti, wan tie anoda collabo nut with the king of juju music, King Sunny Ade.
Thursday, June 27, 2013
Africa's Biggest Event
Yes oh! make una check out the biggest event wey wan dey about to land for Africa. na the launching of Ebonylife TV,with Steve Forbes the founder of forbes magazine wey go dey present.. Ebonylife TV go dey your Dstv for channel 165 starting from July1st wey dem go launch am. Ebonylife TV believe sey na time for Africa to yarn her own story for her own way wey she understand.. hmm, dem also believe sey na time to present another Africa wey person never use eye see b4.......my country people u fit use dis link to watch Ebonylife TV commercials http://bit.ly/17jdE4b and u fit also tidy dis link to find out more about Ebonylife TV http://t.co/Jz2JHvDU7Z .....na so the matter be ooooo!
Subscribe to:
Comments (Atom)